By: Esther Ayoola
Wife of Oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don condemn di way Jaguda boys take abuse some women and girls during di Alue-Do cultural festival for Ozoro, Isoko North LGA, Delta State on Sunday.
She put for statement, say di viral video show di girls suffer barbaric and degrading treatment for wetin suppose be normal community celebration.
Senator Oluremi hail di police wey don make some arrests and urge di authorities to make sure say, all di perpetrators face justice.
She also advise di victims make dem seek proper medical and psychological help to heal from wetin happen.