By: Esther Ayoola
Former Vice Presido Atiku Abubakar don raise alarm, say haters dey drag am wetin nor good which be say im don retire from politics
For statement wey im media aide Paul Ibe drop for X on Monday, Atiku say di rumor wey dey spread for social media say im comot politics, say na big lie
Di senior man say im mout di African Democratic Congress progress for di 2027.
Atiku come make am clear say if im wan take dat kind of big decision like to leave politics, e no go pass through unofficial channels.