At least three pipo don kpai as gunmen try attack Hyeipang community for Jos, Plateau State on Sunday, but security men stop dem and gbab one suspect.
Plateau State Police Commissioner, Bassey Ewah, naim dey brief journalists on Monday about di attack, say e hapun, even as di state dey recover from di Palm Sunday attack
Ewah explain say police, with other security agencies, don put more men join, including Special Intervention Squad and Counter Terrorism Unit, to patrol di areas and make sure such attack no succeed again.