Independent National Electoral Commission don deny report say, dem nor copy post any press statement from a Special Assistant to President Bola Tinubu on New Media, Dada Olusegun, describing di report fake and misleading.
According to statement wey INEC secretary, Adedayo Oketola sign, di mata dat INEC Chairmo, Joash Amupitan, repost All progressive congress post for X na fake rumour.
Say di allegation post wey go viral for X say na bad belle pipo wan spoil INEC chairmo name.
INEC explain say na cybercriminals dey create fake accounts with di chairmo name to deceive pipo.