Nigerian Air Force don start investigation over report say dia air strike wey hapun on April 11, 2026, hit market for Jilli, Borno State, wey cause civilian wujuries.
Dem say, dem dey take any report of civilian harm serious, and dem no wan joke with protection of innocent pipo.
As part of di mata, di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke, don order Civilian Harm Accident and Investigation Cell make dem go di area go find out wetin really hapun.
Meanwhile tori pipo sti meet medical director, Dr Shehu Mohammed of Borno state specialist hospital wia dem konfam say 21 victims of di airstrike dey receive treatment.
Dr Shehu explain every as e take dey for di borno state capital, say dem don begin treatment of di victims already.