By: Esther Ayoola
Di Pipos Democratic Party South-West leaders don praise Seyi Makinde, say im na senior man behind Naija multi-party democracy.
Dem yarn dis one on Monday for press conference wey dem hold for Ibadan.
Party’s Zonal Publicity Secretary, Chief Sanya Atofarati, naim carry im mouth take explain dis mata for di press conference
Im say, Oga Makinde don show true character through im policies and actions, and dat na man im be for democracy.