By: Esther Ayoola
Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve small cabinet reshuffle wey affect two ministers for Federal Executive Council.
Minister of Finance, Wale Edun, go hand over to Taiwo Oyedele wey go become new Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy.
Also, Minister of Housing and Urban Development, Ahmed Musa Dangiwa, go hand over to Muttaqha Rabe Darma wey don dey nominated as minister designate.
According to memo wey SGF George Akume sign, dis changes go take effect immediately, so di new appointees gat start work.