By: Esther Ayoola
Federal Gornment don call, make media, gornment agencies and other stakeholders to do beta collabo to rasca fake news and di speed of wrong information.
Minister of Information, Mohammed Idris, tuk dis one for Abuja during 2026 World Press Freedom Day event wey hapun for Radio House.
According to Idris, dis anyhow doings of fake news dey reduce pipo trust for gornment and fit scarra national unity.