By: Esther Ayoola
For National Assembly for Abuja on Tuesday plenary, Deputy Speaker Benjamin Kalu drop ogbonge update shake everywia say nothing less than 16 House of Representatives members naim don dump African Democratic Congress (ADC) go join Nigerian Democratic Congress (NDC).
According to di lawmakers say dia decision na based on “unresolved crises” for di ADC.
Among di defectors na Yusuf Datti, Uchenna Okonkwo, Adamu Wakili, Thaddeus Attah, George Ozodinobi, Lilian Orogbu, and others wey follow move during the sitting for di Green Chamber.
Di defection hapun for legislative chamber, as dem formally announce am on floor of di House, and more updates sti dey expected as political realignment continue for Naija.