National

Obasanjo Praise Lagos Family Wey Turn Cancer Loss To Campaign To Save Pipo Life

todayJune 1, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Former Presido, Olusegun Obasanjo don praise one new campaign wey dey fight cancer through awareness and early detection.

Baba Obasanjo yarn dis one on Sunday for inside im Presidential Library for Abeokuta, during one event wey ‘Lagos to the World Initiative’ organise.

Di event na for remembrance of di founders wey be mama and sister wey  cancer show shege.

Obasanjo tell di family say wetin dem do make sense, as dem turn dia personal loss to something wey go save plenty regular pipo life.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds