National

How Unknown Gunmen Kpai 4 pipo Attacking Soludo Chief Of Staff Convoy

todayJune 2, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Nor be small mata for Anambra state as some jaguda boys go attack convoy of Governor Chukwuma Soludo Chief of Staff, Chief Ben Nwankwo, for Amansea–Ndiora–Ndiukwuenu–Awa–Ufuma Road in Orumba North Local Government Area of Anambra State on Sunday night, kpai 4 pipo.

Investigation show say two police officers and two civilians wey dey inside di convoy naim kpai as di jaguda boys blast balst di motor.

On Monday night, Anambra Commissioner of Police, CP Ikioye Orutugu, naim lead combined team of police, Nigerian Army and Agunechemba Security Squad go Ndiukwuenu community to inspect di crime scene and assess di situation imself.

Di police boss also reassure residents of di area, as security operatives intensify investigation and deploy tactical teams to track down di attackers and prevent another incident.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds