National

Former Delta State Govo, Okowa Beg EFCC For Im International Passport

todayJune 23, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Former Delta State govo, Ifeanyi Okowa, don reportedly waka go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) office for Lagos to request for im international passport wey dem seize.

According to aproko pipo inside di agency tuk say di visit na part of discussion to allow am collect di travel document so e fit travel go abroad for medical treatment.

Di former govo bin get mata with di EFCC, remember na for November 4, 2024, and dem later question am for EFCC Port Harcourt zonal office as part of ongoing investigation.

One source wey know wetin dey happen tuk say di Lagos visit sti dey linked to negotiations about how dem go release di passport.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds