National

El-Rufai To Throway DSS Case, Say Dem No Get Evidence

todayJune 23, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don prepare to tell court say dem no get enough evidence against am, afta Department of State Services (DSS) close dia case for Federal High Court for Abuja.

DSS dey prosecute El-Rufai on top five-count charge wey involve alleged illegal wiretapping and matter wey touch national security.

Di agency accuse am say im tuk for one live interview in one sitdon media media in February say im intercept phone conversation wey show plan by security operatives to arrest am.

As court mata resume on Tuesday, DSS lawyer Oluwole Aladedoye tell di court say dem no go call anyoda witness again, as dem officially close dia case.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds