Politics

Sign Audit Bill Inside Seven Days Or Resign Now! — Atiku Tell Tinubu

todayJuly 10, 2026 6

Background
share close

By: Jolayemi Olajide

Di Former Vice President Atiku Abubakar on Friday give President Bola Tinubu seven days notice make he sign di Federal Audit Service Bill into law or pack his load comot from office.

Atiku throw dis stones inside one statement wey his Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release for Abuja because Tinubu never act on di bill months after National Assembly send am give am.

Di former VP talk say dis delay dey show say Tinubu dey use executive power play anyhow.

To make sure say transparency dey, Atiku drop  warning say if Tinubu refuse to give reason why he dey hold di bill back, Nigerians no go get choice than to demand make he step down for office.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds