Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di African Democratic Congress (ADC) don blast President Bola Tinubu government, accuse dem say dem dey lie give Nigerians about food matter. For statement wey dia spokesman, Bolaji Abdullahi, release, di party talk say Tinubu administration dey deceive people with fake gist say food don cheap and local production don increase. According to ADC, wetin di government dey do na to “manipulate food price and use hunger take do politics.” Di party yarn say di small drop for food price wey dem dey celebrate na fake, say e happen because of import waivers wey make plenty foreign food enter market, no be because of better government policy. Dem talk say di thing don even spoil market for local farmers wey no fit compete again because of high fertiliser price and insecurity wey dey disturb dem.
ADC still fire di Federal Government say all dis talk of increased food production na propaganda, and say di small drop for price wey Nigerians dey see no go last. “Na manipulation dem dey do for political gain,” dem talk. Di party question di government claim say dem never release imported food, ask why dem go dey hoard food when Nigerians dey hungry. “Which kind government go dey store food when hunger wan finish people?” dem ask. ADC come condemn wetin dem call “weaponisation of hunger,” and call for total overhaul of di country agricultural system before matter go worse pass as e be now.
Written by: News Editor 1
ADC news today food prices in Nigeria political propaganda Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025