National

Adebayo Adelabu Deny Resignation Rumour

todayApril 1, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oga minister of Power, Adebayo Adelabu don deny report say im resign to go contest for Oyo state 2027 governorship election.

Oga Adelabu tuk dis one for TV sit down tuk say di news wey don go viral for social media na fake, as e never write any letter to step down.

Adelabu explain say e stl dey focus on im work as Minister of Power, but at di same time e get interest for Agodi Gornment House as e dey prepare for Oyo State governorship race for 2027 under APC.

According to am, e go make the right move at di appropriate time, as e still dey fully inside di race and no wan rush di process.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app