Sports

Aina Don Back Train After Injury

todayNovember 21, 2025 6

Background
share close

Ola Aina don return to training for Nottingham Forest after im long injury layoff. Di Super Eagles full-back bin sustain hamstring injury while on international duty with Nigeria for September, and e limp commot di pitch for di 10th minute of Nigeria 1-1 draw with Bafana Bafana of South Africa. Di 29-year-old later go under knife and now dey expected to return to action for Forest next month, something wey go be big boost for head coach Sean Dyche as im dey try steer di Tricky Trees comot from relegation zone.

Aina dey also hope say e go fit well in time for di 2025 Africa Cup of Nations wey go shele for December. Di injury don force di former Chelsea defender miss Nigeria last four games. Di 2025 AFCON finals go kick off for Morocco on Sunday, December 21, and Aina dey push hard to make sure say im name dey among di Super Eagles squad when di tournament start.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app