By: Rilwan Agbomeji
Nigerian Army, through Acting Director of Army Public Relations Anele Appolonia, talk on Friday for dem official X pageĀ don clear di air say nor be dem postĀ DSSC 29 recruitment advert wey dey circulate online na fake.
Anele talk say Nigerian Army never announce or approve any Direct Short Service Commission or Short Service Commission recruitment for anywhere for Nigeria at dis time.
Army warn Nigerians make dem no fall victim because scammers dey use di fake advert take deceive pipo and collect money.
She explain say anytime recruitment start, Army go officially announce am through dem website, verified social media pages, newspapers, and oda recognised platforms.