National

Army Rescue 12 Kidnap Victims As Boko Haram Scatter For Borno!

todayDecember 2, 2025 6

Background
share close

By:Alice Iduh

Troops of Operation HADIN KAI don rescue 12 kidnapped people 7 women and 5 pikin  wey Boko Haram carry when dem dey travel for Gwoza–Limankara Road on November 14.

Army yarn say na for Mandara Mountains, Borno State, dem rescue dem on Sunday after dem run coordinated attack under Operation Desert Sanity IV and Diligent Search.

Di soldiers, 26 Task Force Brigade with hunters, vigilantes, and Hybrid Forces, carry out pre-dawn raid, make Boko Haram scatter and leave di captives, wey fear gunshots hide for bush.

Troops sweep the area, find all di victims around 8:45 a.m., and di Army hail di mission as “courage and compassion” on full display.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app