Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) don start dia 18th strike in 26 years, as dem accuse Federal Government say e no gree settle long-standing wahala wey dey affect public universities across Nigeria. For announcement wey happen for Abuja, ASUU President, Prof Christopher Piwuna, order all members to begin total strike from 12:01am, Monday, October 13, 2025, after two-week ultimatum expire with no tangible action from government. E talk say FG just dey do audio promises and no show any serious commitment to ASUU’s seven-point demand.
But di Minister of Education, Dr Tunji Alausa and him deputy, Prof Suwaiba Ahmad, come talk say dem don already present one better offer wey cover staff welfare, university governance, and teaching allowances, dem still dey wait for ASUU’s official reply. Dem warn say if ASUU disrupt academic calendar, ‘no work, no pay’ go kick in. Meanwhile, CONUA, Congress of University Academics, don break rank as dia National President, ‘Niyi Sunmonu, talk say dem no join any strike, and no reason dey to declare one now, since FG still dey negotiate through Yayale Ahmed-led renegotiation committee. Government still dey claim say ASUU no gree show up for face-to-face meeting even after President Tinubu give green light for urgent dialogue and Senator Lekan Tejuoso begin reach out. According to insiders, ASUU shut door on peaceful talk, ignore calls from mediators and go ahead announce strike wey government believe say dem don plan since. FG dey accuse ASUU of bad faith and sabotage, saying di strike no be because of stalemate but pure setup. Ministry of Education yarn say this kain move dey undermine Tinubu administration wey just reconstitute expanded negotiation panel to fast-track solutions to di wahala wey don tey.
Written by: News Editor 1
ASUU strike 2025 CONUA vs ASUU
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025