Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Academic Staff Union of Universities (ASUU) don yan say dem don kickstart negotiation with di federal government over di ongoing strike wey don paralyze activities for public universities. Di union reveal this one for Strike Bulletin No. 2, wey National Strike Coordinating Committee (NSCC) drop and Dr Christopher Piwuna sign over di weekend. Na after dem announce two-week warning strike last week Monday, wey make schools across Naija public universities shutdown.
For di latest update, ASUU talk say dia members dey united and dey stand gidigba for di struggle. Dem talk say progress don dey for some key areas, like release of third-party deductions, payment of promotion arrears, mainstreaming of Earned Academic Allowances (EAA), plus matter wey concern University of Abuja land wey dem seize. Dem still dey tackle cases of victimisation of members for Kogi State University (KSU), Lagos State University (LASU), and Federal University of Technology, Owerri (FUTO). ASUU talk say, “Our members don show better commitment to di struggle. Make we still hold body tight and remain united for di days wey remain.”
Written by: News Editor 2
ASUU and FG Negotiations ASUU Latest News Today
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025