Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down.
Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation.
Among di house wey dem burn na dat of one Malam Ila, di oga of di village, and anoda, plus shop wey dem first loot before set fire on top am. E no good as communities dey suffer like dis and our oga at di top neva yarn any tin on top di gbege.
Written by: News Editor 1
Adamawa Sokoto attack Nigeria bandits news Sokoto bandit attack
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025