Blog horizontal

Background

International

Five Drug Lords Bag 21yrs Jail Over Gabon, Australia Drugs

Five members of international drug cartel don bag total of 21 years jail after NDLEA catch dem with 68.9kg cocaine and tramadol wey dem wan smuggle go Gabon and Australia through Murtala Muhammed International Airport, Ikeja, Lagos. Di suspects, Olasupo Michael Oladimeji, Muaezee Ademola Ogunbiyi and Sola Adegoke, be leaders of one of di drug cartels wey NDLEA nab on August 26, 2025, as dem dey export 17.9kg cocaine hide […]

todayNovember 7, 2025 10

Entertainment

Regina Cry – Make I Dey Show My Sadness And Pain To Una?

Actress Regina Daniels don respond to Nigerians wey dey mock her over her marital wahala. For one video wey she post for her page, Regina talk say e dey okay if people wan laugh at her and talk say when she dey flaunt Ned Nwoko money, nobody dey enjoy am with her. For di video, Regina yan say nobody dey ever flaunt dia sadness because people go dey mock dem. […]

todayNovember 7, 2025 19 41

International

Elon Musk Don Bag $1 Trillion Pay As Tesla Dive Into AI, Robots

Tesla shareholders don gree give Elon Musk di biggest pay package wey world don ever see, $1 trillion deal wey go tie him reward to di company new move into artificial intelligence and robotics. Di approval happen for Tesla annual meeting for Austin, Texas, where over 75% of shareholders vote make e happen. Di pay package go allow Musk unlock stock wey fit reach $1 trillion if him meet heavy […]

todayNovember 7, 2025 15 1

Sports

£800,000 Don Vanish From Bissouma Account

Premier League star, Yves Bissouma, don lose over £800,000 after dem done thief am money from im VIP Coutts bank account. Di £30million Spurs midfielder money wahala start from September 2022 reach June 2024. Maurice Gomes, 31, bin first arrested after Bissouma report am over one year ago. Metropolitan police confirm say Gomes face two counts of fraud by false representation since October, wey fit carry 10 years jail for […]

todayNovember 7, 2025 16

National

FEC Don Okay Concession Of Port Harcourt International Airport, Approve Presidential Task Force For ‘Detty December’

FEC don rise from im meeting for Thursday, approve say dem go give Port Harcourt International Airport to private investors make dem manage am beta and improve service delivery. Dem also approve long-awaited contract for engineering infrastructure for Maitama 2 District for FCT, Abuja. Aviation Minister, Festus Keyamo, talk say di concession no go make any aviation worker lose him job, as government still dey protect workers rights while dey […]

todayNovember 7, 2025 11

Sports

NSC Talk Say Sports Dey Play Big Role For Job Creation

The Chairman of di National Sports Commission (NSC), Shehu Dikko, don yan di strategic role wey sports dey play as catalyst for youth empowerment, job creation, national unity, deepening security and international collaboration, while e still reafirm say di Commission dey push ongoing efforts to build globally competitive and sustainable sports system for Nigeria under di current government. Dikko yan dis one for di inaugural CNN Global Perspectives: On Africa […]

todayNovember 7, 2025 12 100

National

FEC Don Approve ₦43bn For Lagos–Ibadan Expressway, Dem Review Key Highway Contracts Across Nigeria

FEC don approve over ₦43bn for Lagos–Ibadan Expressway Phase II, Section II, plus dem don revise and award new federal highway projects across Nigeria. Works Minister, Dave Umahi, yarn reporters say di fresh approval go cover extra works wey include flyovers, underpasses, ramps, concrete pavement, and adjoining roads wey no dey di earlier phases. Di project wey dem first award five years ago never start, but when Mr. President come, […]

todayNovember 7, 2025 14 48

Sports

Nigeria’s Nnadozie Don Get Nomination For 2025 FIFA The Best Award (FULL LIST)

Super Falcons’ Chiamaka Nnadozie don get nomination for FIFA “The Best” women’s goalkeeper of di year award, as reward for her solid form for both club and country for 2025. Di Nigerian goalkeeper shine for WAFCON wey dem win for July, conceding only three goals in di whole competition. FIFA talk say Nnadozie dey shortlisted based on her performances from 11 August 2024 to 2 August 2025. Dem highlight say, […]

todayNovember 7, 2025 12 21

National

Anambra Don Declare Friday As Work-Free Day For Governorship Election

Di Anambra State government don officially declare Friday, November 7, 2025, as work-free day for all civil servants. Di order take effect immediately and e come just before di important governorship election wey go happen for Saturday, November 8, 2025, for di state. Dis information come out inside one statement wey Head of Service (HOS), Mrs. Theodora Igwegbe, release on Thursday, November 6. Di HOS talk say Governor Chukwuma Soludo […]

todayNovember 7, 2025 14

Entertainment

Bbnaija Season 10 Winner, Imisi, Don Reveal Say She Lose Her Baby Just Weeks Before She Go Audition For Di Reality Show

BBNaija Season 10 winner, Imisi, don reveal say she lose her baby just few weeks before she go audition for di popular reality show. She yarn di heartbreaking gist during one recent interview for TVC Entertainment, where she talk small about di experience. For her words, she say, “I lost my baby this year April. E never even reach one month before I audition for Big Brother. Di whole thing […]

todayNovember 7, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app