Lagos

1135 Results / Page 1 of 127

Background

Lagos

Building Fall for Fadeyi, Kpai One PesinĀ 

One pesin don kpai, as rescue team bring out three men alive after one two-storey building wey dem dey build fall for Akinola Street, near Fadeyi Bus Stop, along Ikorodu Road, Lagos, early Friday morning. Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA, tok say dem receive call for 12:10 midnight, and dia rescue team reach di place two minutes later. As dem dey dig through di broken blocks, dem hear pipu […]

todayOctober 23, 2026 6

Lagos

Navy Seize 1900 KG of Cannabis, Gbab 25 Pipu Wey Hide for Ship

Nigerian Navy don seize about 1900 KG of cannabis and gbab 25 pipu wey hide inside commercial ship for Lagos waters and nearby areas. Commander of Nigerian Navy Ship Beecroft, Commodore Adams Aliu, yarn dis one on Wednesday for meeting with pipu wey dey work for sea business for Apapa, Lagos. E talk say dem carry out di operation to stop cannabis trade, smuggling, illegal oil bunkering and oda criminal […]

todayOctober 22, 2026 6

Lagos

NAFDAC Bust One Illegal Herbal Product Factory for Inside Lagos

NAFDAC don bust one illegal factory wey dem dey use produce herbal products for Agege, Lagos State. Di agency announce dis one for dia verified X account on Wednesday, say dem begin dia touchlighting after one report cast one herbal products wey carry fake NAFDAC registration numbers. NAFDAC say im investigation team monitor di place before dem discover three different types of Asheitu Adams Bitters wey carry NAFDAC registration number […]

todayOctober 22, 2026 9

Lagos

Lagos Agency Teach Girls How to Fight Sexual Abuse

Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency don launch Smart Teens Advocacy Initiative to teach teenagers how dem go take spot, prevent and report sexual abuse. Di programme start on Tuesday for Girls Senior High School, Agege, with 320 students from different schools. Di agency boss, Titilola Vivour-Adeniyi, urge parents and teachers make dem listen to children, support dem and protect dem anytime dem report abuse.

todayOctober 21, 2026 7

Lagos

Lagos Police GbabĀ Two Suspected Cultists, Recover Pistol for Ajah

Di Lagos state police do small robocop doing don go krampĀ  two suspected cultĀ  jaguda boys, Idris Rasak, , and Ibrahim Kazeem, around Addo Road, Ajah, Lagos. Na di state police tok tok pesin, SP Abimbola Adebisi, porporly dis update, say operatives of di Violent Crime Response Unit naim do di arrest based on correct infomate wey reach di police table. Di police say di suspects confess say dem belong […]

todayOctober 21, 2026 8

Lagos

Sanwo-Olu Appoint Dr Hassan Sanuth As Di New LAWMA Oga

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, don appoint Dr Hassan Sanuth as new Managing Director of LAWMA, as reports say e don tell di former oga, Dr Muyiwa Gbadegesin, make e comot from seat because of di dirty wey gather for different parts of Lagos. Di matter follow complainsĀ  about plenty dirty wey dey block road, residential areas and gutters and canals, even after gornment don give order to clear dem, […]

todayOctober 20, 2026 8

Lagos

Lagos APC Members Ready To Put Body For Tinubu and Hamzat

National Chairmo of APC, Prof. Nentawe Yilwatda, Lagos party Chairmo, Cornelius Ojelabi, and baba Govo, Babajide Sanwo-Olu don tell all Lagos APC members make dem deliver di state for Presido Bola Tinubu for 2027. Dem make dis strong call on Monday for Eko Hotel and Suites inside Lagos during one special one-day retreat for party leaders and senior members of de PBAT-KOH Campaign Council. Di party leaders drag di matter […]

todayOctober 20, 2026 8

Lagos

Lagos Taskforce Gbab Former Member For Oshodi

Lagos State Taskforce don arrest one dismissed officer, Yahaya Salami, wey dem also dey call Adams, for impersonation and extortion around Oshodi Bus Stop. Dem catch Salami on Saturday after im try drag with Taskforce officers wey call am for questioning. Dis arrest dey come after one video go viral for social media showing how officers take forcibly hold di suspect down, which make people dey tok online. Inside statement […]

todayOctober 19, 2026 9 2

Lagos

Lagos GornmentĀ Ready To Use Money Take Slap Developers Face

Lagos State Gornment don give serious warning to developers and construction workers make dem stop to dey dump building materials on top roads and inside gutter, or dem go seal dia site and slap dem with heavy fine. Senior man, Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, fire dis mata one on Sunday as e dey do inspection work around Lagos Island area. Senior man see things upon things, […]

todayOctober 19, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds