Lagos

1066 Results / Page 1 of 119

Background

Lagos

Lagos Area Boss Kpai Man Wey Just Return From Obodo Oyinbo

By: Mariam Ajayi Some area jaguda boys  beat persin, him name na Basit, di man kpeme, say di man wan bin do hit and run. Di victim, wey just bounce back to Naija from obodo oyinbo and get wedding to do in two weeks, bin yam one resident for Patey area before boys chase am catch. Eye-witness, Afolabi Lawal, explain say di angry area boys use bottle and heavy stick […]

todaySeptember 7, 2026 3

Lagos

Lagos Gov Aide Knock Buchi Over Lagos Tok

By: Mariam Ajayi Lagos Gorfnor media aide, Gboyega Akosile, don knock content creator Solomon Buchi over im comment about foreigners visiting Lagos. Akosile make di response on X on Friday, saying Buchi dey show bitterness towards Lagos instead of using di opportunity to promote other parts of Nigeria. Akosile say di nightlife and cosmetic surgery culture wey Buchi criticise na part of wetin still dey make Lagos nightlife attractive to […]

todaySeptember 4, 2026 7

Lagos

Sanwo-Olu Beat Chest Say Nigerians Dey Feel Jagaban

By: Mariam Ajayi Sanwo-Olu don hail Tinubu as man of the pipo, say some pipo dey look am with suspicious eyes. Senior man talk this one on Thursday for the 7th Freedom Online Annual Lecture wey hold for Ikeja, Lagos. E use the August 15 Osun election wey opposition Governor Ademola Adeleke win take give example, say Tinubu dey work day and night to bring better democracy to Nigeria.

todaySeptember 4, 2026 8

Lagos

Pensioners Protest Lagos Security Men Tear-Gas Dem

By: Mariam Ajayi Civil society groups don condemn Lagos Gornment over alleged tear-gassing of pensioners. Di elderly pensioners protest for Lagos Assembly, demanding payment of their outstanding pensions and gratuities. CSOs don call for investigation and accountability over di incident. Dem say e dey worrying say security operatives dey disrupt peaceful protests, especially when elderly people dey involved.  

todaySeptember 3, 2026 9

Lagos

Lagos Get 10 Private Hospitals For Every One Public Hospital

By: Mariam Ajayi Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don reveal say private health facilities for Lagos outnumber public hospitals 10 to one. E say public hospitals still dey handle about 40 per cent of patient visits, putting serious pressure on dia facilities. Abayomi say dis pressure dey help informal health providers spread across di state. E say new task force go strengthen monitoring and protect patients for both public […]

todaySeptember 3, 2026 7

Lagos

Nigeria Start New TV Audience Measurement System for Lagos

Nigeria don start new system to measure how people dey watch television for Lagos, using special People Meters wey go record di channels and programmes viewers dey watch. Di initiative na joint project of NBC and ARCON, wey appoint First Media Entertainment Integrated Limited, FMEIL, in partnership with First Media Entertainment Integrated Limited to run di system and select panelists. Di FMEIL/GARB chairman, Rotimi Pedro, say di project don dey […]

todaySeptember 2, 2026 11

Lagos

Flood Take Over Abuja Roads, Traffic Jam Scatter Everywhere

By: Kofoworola Olayinka Heavy rain don cause serious flooding for parts of Abuja, as roads and streets dey under water. Airport Road and Lugbe na among areas wey suffer pass, with flooding also reported around Nile University Junction, Airport Junction and Wuye. Di flood don cause serious traffic wahala, as motorists dey slow down and some dey find alternative routes to avoid di affected roads. Residents don raise concern over […]

todaySeptember 2, 2026 12

Lagos

Lagos Police Promise Ogbogbo Collab With NYSC Corpers

By: Mariam Ajayi Lagos Police commissioner of  police Fatai Tijani don promise NYSC corpers say dem go protect corps members. Tijani give di assurance on Tuesday during a familiarisation visit by NYSC Lagos Coordinator Mrs Christiana Salmwang to di police headquarters for Ikeja. Di meeting focus on strengthening di relationship between both organisations and improving security arrangements for corps members wey dey serve for different parts of Lagos. Tijani say […]

todaySeptember 2, 2026 5 2

Lagos

Sanwo-Olu Ask Why Lagos Pensioners Dey Vex

By: Mariam Ajayi Oga Govo Babajide Sanwo-Olu don arrange meeting with Lagos pensioners on Thursday, as e wan hear why dem dey vex. Di pensioners don dey protest for Alausa, say government never pay dem dia entitlements for two years, after dem serve Lagos for 35 years. Dem say dem don tire to wait, as dem dey demand make government pay wetin dem don work for.

todaySeptember 2, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds