Blog horizontal

Background

Sports

We Don Sabi Falcons Well Well Now — Benin Coach

Head coach of Benin Republic women national team, Abdoulaye Ouzerou, don talk say him girls get better chance to beat Super Falcons and grab di 2026 Women’s Africa Cup of Nations ticket after dem don study di Nigerian team well from dia first leg match last week. Di Amazons of Benin go face Nigeria again for di second leg of di WAFCON qualifier for Abeokuta on Tuesday (today). Coach Justin […]

todayOctober 28, 2025 8

Sports

Green Falcons Wan Build On Top World Series

Despite say dem miss out on di ticket to di 2026 Rugby League World Cup, Nigeria women national rugby league team di Green Falcons still dey hold dia head high after dem return from di 2025 IRL Women’s Rugby League World Series wey happen for Terry Fox Stadium, Canada. Di Green Falcons lose 62–4 to Fiji for di final wey happen on Sunday, wey end dia hope to grab di […]

todayOctober 28, 2025 12

Lagos

NDLEA Burst Lagos Club, Carry Owner And Him Boys For Drug Wahala

Operatives of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don burst one drug party wey happen for Proxy Night Club, Victoria Island, Lagos, on Saturday night, arrest over 100 people, including di club owner, Mike Eze Nwalie Nwogu aka Pretty Mike. Di NDLEA officers wey don already dey inside di party since 11pm scatter di groove around 3am Sunday morning, after dem get correct intel say na drug party dey […]

todayOctober 27, 2025 9

National

Police Carry Two Suspects, Kill Robbery Plan For Bauchi

Police for Bauchi don foil one robbery and carry two armed robbers wey dem catch with two local-made guns plus one stolen motorcycle for Azare town, Katagum Local Government Area. Police spokesman, Ahmad Wakil, yarn journalists say di matter happen on Saturday when one person for Gandum Wambai area report say armed men don enter im business, GKY Food and Oil Mills, threaten di people and run comot with him […]

todayOctober 27, 2025 14

National

Dangote Vow Say Fuel No Go Scarce Dis Ember Months

Aliko Dangote, President of Dangote Industries Limited, don assure Nigerians say dem go get enough petrol (PMS) supply during di festive Ember months. Dangote yarn dis on Sunday as e announce say Dangote Petroleum Refinery go expand from 650,000 barrels per day to 1.4 million bpd. E talk say despite di recent global oil price spike, petrol price no go rise during di season. Dangote also yarn say di refinery […]

todayOctober 27, 2025 27

Lagos

Midnight Demolition Tear Oworonshoki Lagos

Residents of Ojulari, Oworonshoki, Lagos, report say demolition people return late Saturday night to pull down houses for dia community, and dem still dey continue di work reach Sunday morning despite protests and local wahala. Eyewitness yan say two bulldozers dey for di site, while over 50 police officers dey fire teargas for people all through di night. Olarenwaju Segun, one resident, talk say, “We no sleep at all because […]

todayOctober 27, 2025 23

Lagos

Plenty People Dey Trapped As Two-Storey Building Don Collapse For Lagos

Tragedy jam Lagos for early Monday as two-storey building don collapse, plenty people dey trapped under di rubbles. Di incident happen for No. 54, Cole Street, Cemetery Bus Stop, by UBA Bank, Oyingbo, Lagos. Lagos State Fire and Rescue Service (LSFRS) talk say dem receive distress call by 00:20 hours, and rescue teams from Sari Iganmu Fire Station reach di scene sharp sharp by 00:29 hours to start emergency operations. […]

todayOctober 27, 2025 12

Lagos

“Police Warn Sowore And Others Make Dem No Protest Over Lagos Demolitions”

The Lagos State Police Commissioner, Mr Olohundare Jimoh, don warn activist, Omoyele Sowore and others make dem no dey mobilise protest over di recent demolitions wey happen for Lagos. Jimoh talk dis one as e dey yan with journalists for Iyana-Oworo near Third Mainland Bridge on Monday. E yan say police don deploy plenty men across di city to stop any kind demonstration wey fit scatter peace. E talk say […]

todayOctober 27, 2025 13

International

Israeli Hostage Families Dey Demand Make Dem Pause Gaza Ceasefire Plan

Di families of Israeli hostages for Monday don demand say di next step for di US-brokered Gaza ceasefire make dem put on hold until Hamas return di remaining bodies of dead captives. Di Hostages and Missing Families Forum talk say, “Hamas sabi exactly where every deceased hostage dey. Two weeks don pass since di deadline wey di agreement set for return of all 48 hostages, but 13 still dey Hamas […]

todayOctober 27, 2025 14

National

JAMB Clear 85 Underage Candidates For Special Admission

Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don announce say 85 underage candidates don successfully pass dia tough screening process for exceptional admission enter tertiary institutions. According to di statement wey di Head of Media, Dr Fabian Benjamin issue on Monday, all di 85 candidates dey under 16 years as of September 2025 and dem qualify after multi-stage evaluation. JAMB talk say di 85 candidates don notify make dem proceed […]

todayOctober 27, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app