Blog horizontal

Background

Lagos

32-Year-Old Woman Fall Inside 60-Foot Well For Ikorodu

One 32-year-old woman don land hospital after she fall inside 60-foot deep well for Agric Road, Ikorodu, Lagos. According to Lagos State Fire and Rescue Service (LSFRS), di woman, wey dem say dey suffer depression, fall inside di well early Wednesday morning. Di Controller General, Margaret Adeseye, yarn say dem receive distress call and rush go di scene. Preliminary report show say di woman waka from nearby building and sit […]

todayOctober 16, 2025 21

National

Bayelsa Woman Don Land 7 Years Jail For Trafficking Girls

One 29-year-old woman, Mariam Omokiri, wey come from Delta State, don land seven years jail plus ₦1 million fine as Bayelsa State High Court find her guilty of human trafficking. Di court yarn say Mariam traffic, export, and promote prostitution of young girls. She carry four girls from Bayelsa go Mali and Senegal to go hustle ashawo work. Na National Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons and Other […]

todayOctober 16, 2025 16

Sports

Eagles World Cup journey No smooth – Ekong Yarn

Super Eagles skipper, William Troost-Ekong don open up say Nigeria journey to di 2026 FIFA World Cup still long and no easy at all, even though dem don qualify enter di CAF Play-off Tournament wey go happen for Morocco next month. Na after dem knack Benin Republic 4–0 for Uyo on Tuesday give dia best performance so far for di qualifiers. But even with dat kind big win, e no […]

todayOctober 16, 2025 12

Sports

Argentina Knack Colombia 1-0 To Book Final Spot Against Morocco

Argentina and Morocco don qualify reach di final of di 2025 FIFA U-20 World Cup after Argentina narrowly beat Colombia 1–0 for dia semi-final clash on Thursday. Na Mateo Silvetti score di only goal for 74th minute after Gianluca Prestianni tear space for right flank and give am correct assist wey e blast enter from di centre of di box. Di game hot as Colombia later collect red card wey […]

todayOctober 16, 2025 26

International

One kpai, Plenty Wound For Peru Anti-Crime Protest

At least one man don die and over 100 people wound as serious katakata bust during anti-crime protest for Peru capital on Wednesday. President Jose Jeri, wey just enter office some days ago, no fit stop di anger wey full street against di political class. Di Ombudsman Office yarn say 102 people injure, 24 civilians and 78 police. Di protest wey youths lead, carry thousands of angry Peruvians wey vex […]

todayOctober 16, 2025 15

National

Senate Go Screen Prof Joash Amupitan As New INEC Chair Today

Senate go screen Prof. Joash Ojo Amupitan for di position of INEC Chairman today (Thursday) after President Bola Tinubu nominate am. Dis matter waka quick as Tinubu letter asking Senate to confirm Amupitan waka floor just 24 hours ago, and Senate prepare to do di screening for National Assembly Complex. Amupitan nomination follow di National Council of State approval last week, as Prof. Mahmood Yakubu don waka go after 10 […]

todayOctober 16, 2025 17

National

Blind People Dey Beg For Inclusion, Make Govment Support Dem For Lagos

 Di Nigeria Association of di Blind, Lagos Chapter, don call on govment and everybody for society make dem support people wey no dey see well, by promoting inclusion and making things easy for dem. Dem talk dis one on Wednesday during 2025 International White Cane and Safety Day celebration wey happen for St. Paul Anglican Church, Ilupeju. Di theme na “White Cane, My Identity.” Di association use di event take […]

todayOctober 16, 2025 11

International

“Instagram Wan Limit Teenagers To PG-13 Content, Come Tighten Parental Control Join”

Meta don announce say from now, teenagers wey dey use Instagram go dey restricted to only PG-13 content by default, and dem no go fit change di setting unless dia mama or papa give permission. This one mean say teens go dey see photos and videos wey be like wetin dey PG-13 films, no sex, no drugs, and no dangerous stunt videos. Meta say dem go hide or no go […]

todayOctober 15, 2025 15

International

“Hamas Do Public Execution For Gaza, E Don Put Ceasefire With Israel For One Kain Corner”

Hamas fighters don tighten dia grip for Gaza after dem do public execution of seven men wey dem say dey work with Israel. Di video of di execution wey circulate late Monday show how armed men drag di suspects enter middle of crowd for Gaza City, force dem kneel down, then shoot dem from back. Hamas confirm say di video na real. On Tuesday, witnesses and residents say Hamas gunmen […]

todayOctober 15, 2025 17 1

Sports

“List Of Nine African Countries Wey Don Qualify For 2026 FIFA World Cup, One Still Dey Hustle For Playoff Spot”

Africa don ready for dia biggest show for FIFA World Cup as nine countries don already qualify for di expanded 2026 tournament wey go happen for Canada, United States and Mexico. Di countries wey don book dia space be: South Africa, Egypt, Ghana, Algeria, Senegal, Morocco, Tunisia, Cape Verde and Ivory Coast (Côte d’Ivoire). Di 2026 edition go get 48 teams, and Africa don collect nine automatic slots – na […]

todayOctober 15, 2025 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app