Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Dun Tell Pikin Dem Say Make Dem Raise Alarm Incase Anybody Dey Abuse Dem.

Lagos government, through its Domestic and Sexual Violence Agency, don beg pikin dem make dem speak out anytime dem face any kind violence or abuse. Na di Executive Secretary of DSVA, Titilola Vivour-Adeniyi, drop this advice during their ‘Safeguarding and Child Protection Day’ wey happen on Monday for Ikeja. Ms Vivour-Adeniyi talk say Child Protection Week na part of Lagos State Domestic and Sexual Violence Awareness program wey dem plan to protect pikin dem. She talk say pikin dem need […]

todaySeptember 23, 2025 15

Lagos

Lagos Drop Athletes Wey No Dey Perform, Bring in New Stars

Lagos State Sports Commission don begin recruitment of new athletes into their senior team after dem disband the old team wey dem label as “unproductive and undisciplined.” On Friday, the Director General of the Lagos State Sports Commission, Olalekan Fatodu, officially dissolve Team Lagos, and come direct say make only the “productive ones” reapply for new opportunity. People dey believe say the decision no be ordinary, as e fit get connection to the recent protest wey some senior athletes do […]

todaySeptember 23, 2025 15

Lagos

Lagos Dey Find Investors for Waste-to-Energy and Climate Change Projects

Lagos State government don talk say dem ready to work with investors for areas like turning waste to energy, waste to wealth, and how to manage liquid waste well. Commissioner for Environment and Water Resources for the state, Tokunbo Wahab, talk this one when he show face as one of the panellists for Harvard University Climate Action Week, wey theme be: “Rising Seas, Resilient Communities, Climate Adaptation Strategies in West Africa.” According to am, the current government for Lagos don […]

todaySeptember 23, 2025 19

Lagos

Dangote CNG Trucks Don Start to Deliver Fuel to Filling Stations for Lagos

Dangote Petroleum Refinery & Petrochemicals don begin supply petrol give petroleum marketers for different areas of Lagos using their new trucks wey dey run on compressed natural gas (CNG). One of the trucks wey carry Dangote logo bin dey offload fuel for Conoil filling station wey dey directly opposite Ikeja General Hospital. This move na one big step to change how fuel dey move around Nigeria, reduce transport wahala and make fuel reach customers faster and cheaper. The truck, wey […]

todaySeptember 23, 2025 11

Sports

Dembele And Yamal Dey Run Race For Ballon d’Or Glory

Paris Saint-Germain forward Ousmane Dembele dey gats hold body pass Barcelona star Lamine Yamal to win men Ballon d’Or on Monday, while Aitana Bonmati fit carry third women Ballon d’Or back-to-back. Football world go gather for big big ceremony for Theatre du Chatelet, Paris, to know who go be next winner of award wey Lionel Messi and Cristiano Ronaldo don hold for long time. Those two na im win Ballon d’Or 13 times between 2008 to 2023. Di award, wey […]

todaySeptember 22, 2025 50

Sports

“Di Fixture Schedule No Fair To Man City” – Silva Yarn

Manchester City midfielder Bernardo Silva talk say him team dey for disadvantage against Arsenal because of how Premier League take arrange di fixtures. Gabriel Martinelli score for added time to give Arsenal 1-1 draw for Emirates Stadium on Sunday. City get 66 hours to prepare for di match after dem 2-0 home win against Napoli for Champions League on Thursday. Arsenal win 2-0 against Athletic Club for Bilbao on Tuesday. "E no fair to play one of these games like […]

todaySeptember 22, 2025 20

International

Peru Don Mark Second Day Of Gbege Anti-government Protest

Plenty anti-government protesters for Peru capital Lima jam street again on Sunday after gbege wey injure like 18 people, police and journalists join body. Di youth wey dey lead, “Generation Z,” carry another big march waka go where President Dina Boluarte dey work for downtown Lima, police come full ground dey guard. Trouble don dey boil for Peru since some months now, as gbege with organized crime and extortion don full ground. Plenty people for poll talk say government plus […]

todaySeptember 22, 2025 38

National

Senator Natasha Cybercrime Case Jam Gbege, Dem Push Am Go Oct 20

Trial wey dey go against suspended Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan, for alleged cybercrime before Justice Mohammed Umar for Federal High Court, Abuja, jam gbege after the defendant raise objection. Akpoti-Uduaghan don face court since June 30 on six-count charge wey Director of Public Prosecution of Federation (DPPF), Mohammed Abubakar, file against her. Dem grant her bail, after dat Justice Mohammed Umar adjourn case till September 22 make trial begin. But as hearing resume, prosecution lawyer, David Kaswe, wey bring […]

todaySeptember 22, 2025 14

National

10 People Don Die For Sokoto Boat Gbege

Police for Sokoto don confirm say 10 people die for boat accident for Sabon Birni Local Government Area for di state. Dem talk say di people wey die dey try escape attack wey bandits dey plan for Zalla Bango, one remote village for di council, when di accident happen. Even though national and state emergency people never talk anything about di accident, DSP Ahmed Rufai, Sokoto State Police spokesman, confirm say di people drown. Rufai talk say dem recover di […]

todaySeptember 22, 2025 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app