Blog masonry

Background

National

World Food Day: Dem Dey Tell FG Make E Support Local Farmers, Share Food Well Well

As Nigeria join di rest of di world celebrate World Food Day on October 16, 2025, stakeholders don call on Federal Government to invest in local farmers, promote agroecology, and support better food distribution to make di country food system strong and better for both people and environment. Mrs. Oluremi Kuteyi, di Executive Director of Spectra Industries Ltd for Oko-Oba, Lagos, make di call during program wey di company organize to mark di day. She talk say Nigeria get di […]

todayOctober 17, 2025 31

National

FG Go Add Sign Language Inside Basic School Curriculum

Di Federal Government don announce new policy wey go make sign language teaching and learning dey compulsory for all basic education schools for Nigeria. Dis move na part of dem plan to make education inclusive so that no pikin go dey left behind. Di Executive Secretary of Universal Basic Education Commission (UBEC), Aisha Garba, yarn dis one for Abuja on Thursday during di 2025 International Day of di Girl Child. Di theme na: “Lead a Change: Learn Sign Language Today.” […]

todayOctober 17, 2025 41

National

Man Burn Ex-Girlfriend Inside Oyo Barracks

Di Oyo State Police Command don confirm say dem don arrest one man wey im name be Lawal Faruq, wey allegedly burn im ex-lover, Omolola Hassan, after their relationship scatter. Di incident bin happen for one military barracks for Ibadan, Oyo State capital. One counterinsurgency expert, Zagazola Makama, wey yan for X (former Twitter), talk say di guy claim say him and di babe don swear say dem no go ever break up. But as di love cast, di guy […]

todayOctober 17, 2025 40

Sports

Four Must-Win Battles Wey Go Carry Naija Enter World Cup

Di Super Eagles of Nigeria still dey chase dia World Cup dream after dem knack Benin Republic 4-0 for Godswill Akpabio Stadium for Uyo. Victor Osimhen score hat-trick and Frank Onyeka add late goal wey make Naija finish second for Group C of di CAF qualifiers. Even though di win sweet, Naija still no qualify straight as South Africa top di group with 18 points after dem beat Rwanda 3-0. Bafana Bafana don carry automatic ticket go di 2026 FIFA […]

todayOctober 16, 2025 41

National

Tinubu Yarn Say Naija No Suppose Dey Poor At All

President Bola Tinubu talk say Nigeria get plenty solid minerals and no get reason to dey poor. Dia for 2025 Nigeria Mining Week for Abuja, Tinubu, wey Secretary to Government of Federation, Senator George Akume represent, yan say, “Naija no suppose poor because of dia resources and talented people. Di challenge be to use dia potentials make better life for all. Make we turn minerals to miracles of development. ‘Minerals to Miracles’ suppose be our motto.” Tinubu describe Nigeria Mining […]

todayOctober 16, 2025 42

Lagos

Four Nearly Kpai As Two trailer Jam For Lagos–Abeokuta Road

Four people nearly kpai yesterday when one cement-laden truck jam another moving truck for Lagos–Abeokuta Expressway. Di accident involve two Howo trucks, one red truck with registration number T12926 LA and one ash-coloured truck with number WDL 536 XA. Di Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Corps (TRACE) spokesperson, Babatunde Akinbiyi, confirm di incident for statement wey e drop on Wednesday for Abeokuta. Akinbiyi talk say na four people dey inside di two trucks, but nobody wound and nobody die. […]

todayOctober 16, 2025 40

International

Ted Cruz Wan Make US Pass Law For Nigeria Religious Mata

US Senator Ted Cruz don renew dia push to make law wey go punish Nigerian officials wey dem accuse say dem dey involved for religious persecution. For dia official X page, Cruz talk say, “Enough na enough. Congress suppose move my Nigeria Religious Freedom Accountability Act make dem fit push back against di Nigerian officials wey dey cause dis kain yawa.” Di law wey di Texas senator don dey push before, go impose sanctions wey target di people and groups […]

todayOctober 16, 2025 38

International

No Be Play Again – Bear Attack Don Set New Record For Japan

Dis year for Japan, bear dem don kill plenty people reach record high, environment ministry talk on Thursday, just as another possible victim don go miss. Di bears hungry because food like acorns no plenty again, and climate change na di main cause. Because of dis, di bears dey waka enter towns wey population dey old and dey reduce. Experts talk say warm weather dey affect how di bears dey hibernate. Brown bears fit weigh like half ton and dem […]

todayOctober 16, 2025 31

Lagos

32-Year-Old Woman Fall Inside 60-Foot Well For Ikorodu

One 32-year-old woman don land hospital after she fall inside 60-foot deep well for Agric Road, Ikorodu, Lagos. According to Lagos State Fire and Rescue Service (LSFRS), di woman, wey dem say dey suffer depression, fall inside di well early Wednesday morning. Di Controller General, Margaret Adeseye, yarn say dem receive distress call and rush go di scene. Preliminary report show say di woman waka from nearby building and sit down near di well before she mistakenly fall inside. Firefighters […]

todayOctober 16, 2025 43

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds