Blog no sidebar

Background

National

Reps Vex As Wahala Burst Over Lagos Trade Fair Land

Wahala bust for House of Representatives on Tuesday as dem turn di chamber to shouting ground over alleged illegal and criminal sharing of Federal Government land for Lagos International Trade Fair Complex. Di motion wey cause di gbege na from Rep Ademorin Kuye wey talk say make dem set up ad hoc committee to investigate di matter. But many members no gree, dem insist say di standing Committee on Commerce […]

todayNovember 4, 2025 5

Sports

Ronaldo Don Para: “Messi No Better Pass Me!”

Superstar footballer, Cristiano Ronaldo, don open mouth again for di long-time argument wey football fans don dey drag, who be di greatest footballer of all time between am and Lionel Messi. Di Al Nassr and Portugal captain yarn dis one for new interview with British broadcaster Piers Morgan, where e talk say Messi no better pass am. For di interview preview, Morgan ask am, “Dem dey talk say Messi better […]

todayNovember 4, 2025 15

Lagos

Two Suspected Okada Thieves Don Land For Police Net Inside Lagos

Operatives of di Lagos Neighbourhood Safety Corps (LNSC) for Olorunda Command don arrest two suspected okada thieves for Isanmo, Ilogbo area of Lagos State. Di arrest happun around 6:13 a.m. on Monday, November 3, 2025, as di suspects wey pretend like normal passengers try collect one commercial motorcyclist bike. But di sharp-eye LNSC patrol team notice dem suspicious moves, rush go di scene, and foil di robbery before arresting di […]

todayNovember 4, 2025 23

Lagos

Lagos Goment Don Set CAP To Block Illegal, Weak Houses Wey Dey Fall

Lagos State Goment don launch one new Certified Accreditors Programme (CAP) wey go make residents help report any ongoing building wey dem suspect for dia area to Lagos State Building Control Agency (LASBCA) and other regulatory bodies. Di Special Adviser to Governor on e-GIS and Urban Development, Dr. Olajide Abiodun Babatunde, yarn dis one during media briefing about di 70% stage certification fee wey concern building permit. He talk say […]

todayNovember 4, 2025 4

Lagos

Lagos, Fed Govt Join Hand To Stop Illegal Japa Runs

Di Lagos State goment don talk say dem no go rest until dem fight finish human trafficking, illegal japa and smuggling of people waka abroad weh no get permit. Dis one happen for one sensitisation program wey dem tag “Partnership for Protection: Safeguarding Public Servants Against Trafficking and Unsafe Migration” for Lagos. Di event join body of Lagos Ministry of Special Duties with NAPTIP, NiDCOM, Immigration Service, IOM and others. […]

todayNovember 4, 2025 4

Lagos

Lagos Chamber Don Support 15% Tax On Petrol Import

Di Lagos Chamber of Commerce and Industry (LCCI) don hail di new 15% import tax wey federal government slam on petrol and diesel, say e make economic sense well-well. But dem still advise government make e focus on boosting local refinery capacity before di new tax go fully bite. Di Chamber talk say di policy fit help Nigeria stop to depend on foreign fuel and boost local refinery work, but […]

todayNovember 4, 2025 4

National

Reps Adjourn One Week For Unpaid Contractors

Di House of Representatives don adjourn plenary for one week to stand with contractors wey never collect dia money. Dis follow wahala wey happen on Tuesday wen di contractors barricade di National Assembly gate dey protest say di Federal Government never pay wetin e owe dem for jobs wey dem run under di 2024 and 2025 budgets. Rep. Kabiru Maipalace move motion say make di House suspend sitting until di […]

todayNovember 4, 2025 2

National

Troops Kill Scores Of Boko Haram Fighters For Failed Attack On Borno Military Base

Scores of Boko Haram fighters don neutralised on Tuesday as dem try attack Forward Operation Base (FOB) for Kangar, Mallamfatori, Abadam LGA, Borno State. Di attack wey happen about 4:30am was repelled by troops of Joint Task Force, North-East Operation Hadin Kai, with critical air support from Nigerien Air Force. Sources yarn say di insurgents use armed drones and mortars, injuring some CJTF members and soldiers. Troops from main battalion […]

todayNovember 4, 2025 5

Sports

Vitinha Talk Say PSG Vs Bayern Champions League Go Show Who Be ‘Best’

Portuguese midfielder Vitinha talk say Paris Saint-Germain home clash with undefeated Bayern Munich for Champions League on Tuesday go be battle between “di two best teams for Europe.” PSG dey enter di hardest test for dia European title defence, top for French Ligue 1 and don win three out of three games so far. But Bayern don start dia season with European record of 15 wins from 15 matches, and […]

todayNovember 4, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app