Students and workers of
University of Abuja con hang outside school gate today Wednesday, November 18, 2026, as protest over alleged land grabbing by Federal Capital Territory Minister
Nyesom Wike enter him third day.
School unions like Academic Staff Union of Universities(ASSU), Senior Staff Association of Nigerian Universities(SSANU), and National Association of Academic Technologists(NAAT) join body block di main school entrance, dey beg Presido Bola Tinubu make e torchlight di matter, call Minister Wike to order, and stop am from sharing di school land give private pipo.
For him own side, di Minister yeye di protest, press mouth say na 2016 committee report e follow cut di school land, and tell di unions make dem go court if dem nor like am.