foreign

41 Results / Page 5 of 5

Background

foreign

Australia Tighten Gun Laws Afta Deadly Bondi Shootings

By: Rilwan Agbomeji Australia don declare say dem go tighten gun laws afta one of di worst mass shootings in almost 30 years hit di country. Father and son burst Hanukkah festival for Bondi Beach on Sunday, open fire wey kill 15 people including small pikin. Crowd scatter scatter for Sydney beach, people dey run for dia life as bullets dey fly. Among di dead na 10-year-old girl, one Holocaust […]

todayDecember 15, 2025 15

foreign

How Tanker Wey US Seize Take Hide Im True Location

By: Rilwan Agbomeji US authorities don confirm say dia forces seize one vessel for Wednesday evening afta helicopter raid near Venezuela coast. Reports match di ship wey dem see for US footage with Skipper, using photo from TankerTrackers.com wey dey monitor oil movement. Tracking data show say di vessel never report its location since 7 November, and maritime analysts for Kpler even believe say e do ship-to-ship transfer to cover […]

todayDecember 11, 2025 18

foreign

Jaguda Boy Use Hand Touch Bristol Museum ,Thief 600 Artefacts

By: Alice Iduh Bristol  for inside United kingdom dey shake say, some Jaguda boys enter dia museum thief about 600 of dia precious artefacts wey dey show link between Britain and former British Empire don vanish. Police talk say dem comot am for museum since September 25. Avon and Somerset police don release CCTV wey show four men wey police dey find, dem dey outside di building wey hold di […]

todayDecember 11, 2025 17

foreign

UK PM Starmer – China Na Big Security Wahala, But Trade Still Dey

By: Rilwan Agbomeji UK PM Keir Starmer don yarn say China na gbege wahala for UK security, but im still talk say dem no fit chop Beijing belle, because money and business no dey play. Na for Monday night meeting im yarn am sharp, drag di old Conservative government say dem sidon sleep make UK–China mata turn complete yawa, with espionage gist dey scatter everywhere. Starmer remind everybody say since […]

todayDecember 2, 2025 14

foreign

Cash Don Finish For Sudan, Pipo Dey Swap Goods, Run Credit

Sudan economy don kpafuka, money don vanish comot, everywhere don turn wahala zone, one euro wey before dey 450 pounds now dey sell 3,500 for black market, money don disappear everywhere. Banks don loot, cash don vanish, people don dey swap everything, chairs, hoes, cloth, even fridge, just to chop, buy fuel or run generator. Civil servant Ali for Dilling talk say e never see banknote for over nine months, […]

todayDecember 1, 2025 61

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds