Local

127 Results / Page 1 of 15

Background

Local

NEMA Warn River Niger Communities Make Dem Ready for Flood

By: Kofoworola Olayinka NEMA official Madukwe don warn people wey dey live near River Niger and other flood-prone areas to stay alert and ready move to safer places if flood palava start. She say residents no suppose wait make water enter dia houses before dem take action, because early preparation fit reduce di damage flood fit cause. Madukwe say NEMA, SEMA and Nigerian Red Cross go continue to monitor River […]

todaySeptember 11, 2026 12

Local

Otti Wife Give 400 Women With Disabilities N20m Support

By: Kofoworola Olayinka Abia Gofnor Wife Priscilla Otti don give N20 million and food items to 400 women wey dey live with disabilities for Umuahia on Friday. Otti, through her Safe Tent Care Initiative, say di support na to help women wey dey face financial hardship and make sure dem no dey left behind. She say her office don dey support people with disabilities since 2023, with plans to train […]

todaySeptember 11, 2026 11

Local

Sunday Igboho Stop Police Arrest of Tani Olohun

By: Mariam Ajayi Yoruba Nation activists, Sunday Igboho, block police attempt to arrest Isese advocate, Abdulazeez Adegbola, popularly known as Tani Olohun. Footage shared on Tani Olohun Facebook page show confrontation between police officers and residents who gather as dem come to arrest am. One of di videos show one police officer pin Olohun to ground while residents gather around di scene. Di reason for di planned arrest no dey […]

todayAugust 26, 2026 17

Local

Lagos Gornment Install New Onise, Charge Am To Unite Ise Kingdom

By: Mariam Ajayi Lagos State Government don officially install Ibrahim Saliu as di new Onise of Ise Kingdom for Ibeju-Lekki. Government present di Staff of Office and Instrument of Appointment to am last Friday, after di death of former monarch, Ganiu Adegbesan. Special Adviser to di Governor on Rural Development, Nurudeen Agbaje, charge di new monarch to unite all di royal families and promote peace for di kingdom. He also […]

todayAugust 24, 2026 13

Education

Edo Deputy Governor Gives Student N1m For Straight As In WASSCE

By: Mariam Ajayi Edo State Deputy Governor, Dennis Idahosa, don reward Delight Amayaenvbo with N1 million cash for recording straight As for West African Senior School Certificate Examination, WASSCE, as he hail di student’s hard work and determination.   Idahosa present di cash gift to Delight for Edo State after di student’s outstanding result attract his attention, with di deputy governor saying di achievement don make dia family and di […]

todayAugust 20, 2026 18

Local

Katsina Governor Flags Off 90,000 Bags Of Grains For Vulnerable Families

By: Mariam Ajayi Katsina State Governor, Dikko Radda, don flag off distribution of 90,000 bag of assorted grains to vulnerable household across di state 34 Local Government Areas on Wednesday, to cushion di effects of economic hardship and strengthen food security. Radda launch di intervention for Kaita Local Government Area, Katsina State, where he direct official and stakeholder to make sure di grain reach di intended beneficiary without discrimination or […]

todayAugust 20, 2026 13

Local

Gunmen Kill 24 People For Plateau Community

By; Mariam Ajayi At least 24 people don die while several others sustain injuries after gunmen attack Binper community for Mangu Local Government Area of Plateau State. Residents say di attack happen between Monday night and early hours of yesterday. One eyewitness, Daniel Musa, say di heavily armed attackers move from house to house, forcing dia way inside homes. E say di gunmen attack residents wey dey sleep, leaving many […]

todayAugust 19, 2026 10

Local

FG To Put 3,700 New Network Towers For Rural Areas

By: Kofoworola Olayinka Federal Gornment don start plan to build 3,700 telecom tower for villages across Nigeria. Communication Minister Bosun Tijani yarn this on Sunday for Ogboghoro Community, Delta State. He say di project go help bring better network to hard-to-reach riverine areas and connect more Nigerian to internet. Tijani say President Bola Tinubu approve di plan as part of gornment effort to build a $1 trillion economy.

todayAugust 17, 2026 14

Local

Security Operatives Rescue Nine Kidnap Victim For Kogi-Edo Border

By: Kofoworola Olayinka Security agency don rescue nine kidnap victim for Kogi-Edo border after joint operation on August 11. Two commissioners inspect police and other security workers wey dey carry out seven-day operation for forest areas and hideout. Police spokesperson ASP Afusat Salihu say di operation improve intelligence sharing and coordination against security threats. She say police, Army, Navy, DSS, NSCDC and local vigilantes rescue di victims and reunite dem […]

todayAugust 14, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds