Niger Delta

13 Results / Page 2 of 2

Background

Niger Delta

Amaewhule Join 15 Lawmakers Waka Comot From PDP

By: Alice Iduh Speaker of the rivers state house of assembly, Amaewhule Martins don waka comot from PDP join 15 oda members of di House of Assembly on Friday, as di session dey go on. Dem talk say di wahala inside PDP na why dem gatz japa comot from di party. Among di big names wey join di waka na Deputy Speaker Dumle Maol, Major Jack, Linda Stewart, Franklin Nwabochi, […]

todayDecember 5, 2025 4

Niger Delta

Edo Governor Don Appoint Dr Ebojele As Chief Press Secretary

By: Alice Iduh Edo State Govo don appoint Dr Patrick Ebojele as new Chief Press Secretary to Govo Monday Okpebholo. Before dis new job, Ebojele dey teach as lecturer for Federal Polytechnic, Auchi. Di appointment, wey Secretary to di State Government, Umar Ikhilor, sign confirm on Thursday, go make Ebojele take over from Fred Itua.

todayDecember 5, 2025 10

Niger Delta

Police Burst Fake Kidnap Story, Arrest Five For Oron

By: Alice Iduh Akwa Ibom Police don grab five suspects wey dem say cook up and spread fake tori of kidnapping for Oron area, causing serious tension for di state. Commissioner of Police Baba Azare reveal di matter on Thursday for security meeting with youth leaders from all 31 LGAs, as him blast di suspects for di reckless stunt. According to am, na dem fabricate di fake gist say students […]

todayDecember 5, 2025 7

Niger Delta

Edo Assembly Fit Arrest Obaseki As Him Sidon Out MOWAA, Radisson Probe

by: Alice Iduh Edo State House of Assembly don fire warning as di ad hoc committee wey dey investigate MOWAA and Radisson Hotel talk say dem get power to issue arrest warrant for former Govo Godwin Obaseki wey refuse show face. Di committee wey Governor Monday Okpebholo order make dem probe how government take pump N3.8bn into MOWAA and N28bn into Radisson Hotel, say di matter don serious pass play. […]

todayDecember 5, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app