by: Alice Iduh
Edo State House of Assembly don fire warning as di ad hoc committee wey dey investigate MOWAA and Radisson Hotel talk say dem get power to issue arrest warrant for former Govo Godwin Obaseki wey refuse show face.
Di committee wey Governor Monday Okpebholo order make dem probe how government take pump N3.8bn into MOWAA and N28bn into Radisson Hotel, say di matter don serious pass play.
Even after MOWAA management send message, the former govo snub di invitation.
di lawmakers don mak am clear dat, nobody fit dodge accountability when public money dey inside.