obodo oyinbo

580 Results / Page 54 of 65

Background

obodo oyinbo

Bill Gates Cancel Last Minute AI meeting

Say area don gather for New Delhi for one ogbonge AI summit, dat Indian leader Narendra Modi go tok, plus tech chiefs like OpenAI Sam Altman. Bill Gates bin suppose tuk too, but e cancel last minute. Gates say im comot body so dat pipo go really focus on wetin AI Summit really mean.  

todayFebruary 19, 2026 32

obodo oyinbo

Peru Fire President Jose Jeri Over Corruption Wahala

By: Esther Ayoola Peru Congress don fire interim presido, Jose Jeri, wey be di seventh presido of di kontri and e don rule  for di last ten years. Dem accuse am say e hire plenty women for him gornment and say e dey linked to one Chinese businessman for corruption wahala. Jeri take over from leader Dina Boluarte, wey dem bin impeach, because pipo complain about di wahala for di […]

todayFebruary 18, 2026 31

obodo oyinbo

President Trump Insist Say Im Go Put Eye For Iran-US Nuclear Tuks

By: Esther Ayoola U.S. Presido, Donald Trump say im go dey “indirectly” involve for di second round nuclear tuks wey go happen for Geneva between US and Iran. Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don already land Geneva for meeting before di tuks proper. Tension for Gulf, still dey high, as US don send another aircraft carrier, and Iran for dia part through dia Supreme Leader Khamenei, say, any attack, go […]

todayFebruary 17, 2026 34

obodo oyinbo

Prime Minister Albanese Insist Say, Australia No Go Rescue ISIS Woman An Pikin From Syria

By: Esther Ayoola Australia Prime Minister Anthony Albanese don clear mata say im govament no go support any jaguda doings and dat  Australian  go send  woman an pikin wey get tie  with ISIS fighters. Untop tuk tuk with tori pipo on Monday, Oga prime minister say e dey “unfortunate” say pikin dem dey involved, but Australia no go look back on dia decision. Albanese say any person wey use im […]

todayFebruary 17, 2026 33

obodo oyinbo

Ukraine Former Energy Minister Galushchenko Land Police Net For Corruption

By: Esther Ayoola Former Ukraine energy minister German Galushchenko don land police net as im dey try japa from di country. U sabi say, e leave gornment last year afta e name show for corruption list. E dey among people wey dem tuk say, dem collect $100m for November embezzlement scandal. Say di mata sef shake President Volodymyr Zelensky gornment wey promise to fight corruption before Russia attack, so like […]

todayFebruary 16, 2026 39

obodo oyinbo

Israeli Soldiers Kpai 11 Palestinians For Gaza, Including Pij Commander

By: Esther Ayoola Israeli soldiers don kpai kpai at least 11 Palestinians for different parts of Gaza, According to hospital authorities, For Jabalia camp, dem hit tents wey displaced people dey, kill five. For Khan Younis, another five people Kpai. Say Dem also kill PIJ commander Sami al-Dahdouh for Tal al-Hawa, east Gaza City, say, di mata, na every day e dey worwor for Gaza.

todayFebruary 16, 2026 30

obodo oyinbo

Budget Wahala Force US Homeland Security Close Shop

By: Rilwan Agbomeji Di Department of Homeland Security don enter partial shutdown on Saturday sake of say US Congress never gree pay dem, especially over ICE operations wey dey cause gbege afta dem kill two citizens for Minneapolis raids. Thousands wey dey work for airport security, disaster relief, and oda DHS units go either carry dia kaya go house without payment or dey continue to work with no salary until […]

todayFebruary 14, 2026 36 18

obodo oyinbo

Seoul Accuse Kim Jong Un Say E Wan Make Im Girl Pikin Next Leader For North Korea

By: Esther Ayoola North Korea leader Kim Jong Un, like dis dey face beta gbasgbose say im dey plan to make im  13 year old girl pikin, Kim Ju Ae,  di  next leader of  North Korea According to  Seaul spy agency,  say di pikin just dey  follow her papa up an down, attend big big events, like im first trip to Beijing for September. South Korea National Intelligence Service  say, […]

todayFebruary 13, 2026 26

obodo oyinbo

China Sharply Blast Israel Move To Grab Palestine West Bank

By: Rilwan Agbomeji China don yarn serious gbege say dem no gree make anybody waka enter Palestinian land, days afta Israel Security Cabinet approve move to grab more West Bank. Lin Jian from China Foreign Ministry talk say dem dey oppose any new settlement for Palestinian area and anybody wey wan chop dia land. On Sunday, Israel Cabinet don give green light make dem build more settlements wey plenty people […]

todayFebruary 12, 2026 30 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds