obodo oyinbo

579 Results / Page 1 of 65

Background

obodo oyinbo

Iran No Gree End War With United States

Diplomatic meeting don dey happun across Middle East as different countries dey try find way to end di war between United States, Israel and Iran. Pakistan Army Chief, Asim Munir, reach Tehran on Wednesday to discuss di war matter and di latest tension for Yemen, as fear dey grow say fresh fight fit burst but Iran still stand gidigba for im position, say di war no go end and Strait […]

todayOctober 22, 2026 6

obodo oyinbo

Iran and US Resume Dia Fight

US Oga Secretary of State, Marco Rubio, don fry mouth tok say, e go dey very hard to end di war for inside iran . Hin porporly dis mata give US news tatafo pipo. US  dey insist say dem go  continue to press Iran until dem stop to dey attack ships for Strait of Hormuz. Mean wider Iran Foreign Minister, Abbas Araghchi, dey press yarns until US agree to Iran […]

todayOctober 21, 2026 6

obodo oyinbo

Qatar Tok Say Iran And US Still Dey Settle Marras

Qatar Foreign Ministry tok tok pesin, Majed al-Ansari, tok say Iran and America still dey negotiate as both sides dey find way to settle dia matter without fight. Al-Ansari tok dis one for Doha, Qatar, as tension dey rise and pipu dey fear say war fit start again between di two countries. E explain say diplomatic talks still dey go on, as Qatar and oda mediators dey try make both […]

todayOctober 20, 2026 6

obodo oyinbo

Drone Attack For Sudan Kpai 100 Pipu

More than 100 pipu naim don kpai since Sunday as drone attacks hit Sudan capital, Khartoum, and two areas for di west wey paramilitary forces control. Say di wickedest of dem all hapun Sunday evening near market for Al-Dibab town, West Kordofan State, wey Rapid Support Forces, RSF, control, dem don dey gbege di  Sudan military since April 2023. According by one resident, Ahmed Abakar Wadi,  wey help bury di […]

todayOctober 20, 2026 6

obodo oyinbo

America No Warn Us Before Russia Bomb Our Tins – Zelensky 

Presido Volodymyr Zelensky don tok say Ukraine allies no give dem any early warning before Russia launch ballistic missiles touch dem energy facilities for Kyiv region. Zelensky reveal say Russia fire 16 ballistic missiles and over 200 drones go different parts of di country overnight, which make loud explosions sound across di capital. Dis attack dey come just one week after Ukraine tok say US no give dem heads-up for […]

todayOctober 19, 2026 6

obodo oyinbo

Heavy Crucifix Pull Off Wall, Kpai Catholic Priest

Wonders dem say e nor get end, na so Catholic priest, Father Patricio Sánchez Molinari, take kpeme for Ecuador, nor be small village pipo doings, say one heavy wooden cross  fall untop am as hin  dey celebrate Mass for Our Lady of Perpetual Help Church for Guayaquil, Ecuador. Dis sad incident hapun on Saturday during one service signature, and di whole thing show live as e dey hapun on top […]

todayOctober 19, 2026 10

obodo oyinbo

Ukraine Russia War No Concern Zelensky – Trump Tok

US Secretary of State, Marco Rubio, on Monday deny say America don suspend intelligence sharing with Ukraine, as e tell Presido Volodymyr Zelensky say make e focus on how to end di war with Russia. Rubio tell tori pipu say no pause dey at all, and when dem ask am about Ukraine, he claim say America stop to dey send intelligence wey go hellep dem fight against Russia missile attacks. […]

todayOctober 19, 2026 7

obodo oyinbo

Dis Priest Nor Know Say Hin Go Kpai For Church

Catholic priest, Father Patricio Sánchez Molinari, don kapi after one big wooden cross wey dey hang behind am for altar fall ontop im head as e dey celebrate Mass for Our Lady of Perpetual Help Church for Guayaquil, Ecuador. Di askident happen on Saturday as dem dey livestream di church service for social media. According to AP report, di priest no be like say e notice when di cross dey […]

todayOctober 19, 2026 44

obodo oyinbo

Macron Vex as France Riot, Say Protesters Go Pay

French Presido Emmanuel Macron don vex oh, scata body for ground dey vex say violent protesters wan brin hin country down. Hin porporly dis mata Inside television tok  Sunday, Macron promise say all di pipo wey dey destroy property, say if hin kramp dem ehn, dem go pay Di country Interior Ministry tok say police gbab almost 2,400 pipo on Saturday alone, as about 1,000 police officers  wunjure for di […]

todayOctober 19, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds