Sports

330 Results / Page 25 of 37

Background

Sports

Barca Player Olmo Fit No Play Clasico After E Calf Injury

Barcelona midfielder Dani Olmo fit no play for di upcoming La Liga Clasico match wey dem go play against Real Madrid after dem find out say e get calf injury on Monday. Barcelona talk for statement say, “Olmo get muscle injury for him left calf, but e no touch any connective tissue,” but dem no talk how long e go take to recover. Spanish media talk say Olmo fit miss […]

todayOctober 14, 2025 5

Sports

Super Eagles Don Finally Land Uyo Afta Mid-Air Wahala

Di Super Eagles don finally land for Uyo, Akwa Ibom, ahead of dia final 2026 FIFA World Cup qualifier match. Dem touch ground for Victor Attah International Airport around 8:05 a.m. on Sunday afta unexpected delay wey happen for air. Di wahala start on Saturday when di team dey fly from Polokwane, South Africa, go Uyo.  Di aircraft, ValueJet wey carry players, coaches, and government officials, first stop for Luanda, […]

todayOctober 13, 2025 11

Sports

Kudus Goal Carry Ghana Go 2026 World Cup

Mohammed Kudus score di only goal as Ghana knack Comoros 1-0 for Accra on Sunday, make dem win Group I and become di fifth African team wey qualify for 2026 World Cup after Algeria, Egypt, Morocco, and Tunisia. Di Black Stars, wey dem cheer with 40,000 fans for di stadium, control di first half but no too pressure Comoros goalie. But after di break, Kudus for Tottenham show sharpness as […]

todayOctober 13, 2025 10

Sports

Rohr: “Cheetahs Ready To Die For Di World Cup Ticket”

Former Super Eagles coach, Gernot Rohr, don talk say tomorrow 2026 World Cup qualifier between Nigeria and Benin Republic na serious do-or-die, as e say di Cheetahs ready sacrifice dia lives to win am because na once-in-a-lifetime chance to play for di biggest sporting stage for di world. Rohr wey dey coach Benin now, dey one step away from history with him underrated Cheetahs wey just need draw to qualify […]

todayOctober 13, 2025 6

Sports

Ancelotti Dey Ready To Make World Cup History With Brazil

No country ever win World Cup wit foreign coach before, but Carlo Ancelotti talk say “first time dey for everything” as e dey plan make history with Brazil. Di Italian become Brazil first coach wey no born for dia own country in 60 years when e start in May, and e help di five-time champions secure dia ticket for next year World Cup. Brazil go face Japan for friendly match […]

todayOctober 13, 2025 8

Sports

NPFL Wahala: Teargas Fly After Pillars, 3SC Draw

Di Nigeria Premier Football League enter spotlight for wrong reason on Sunday as Shooting Stars’ late equaliser cause gbege for Sani Abacha Stadium, Kano. Di high-tension Matchday 8 clash end 1–1, but na afta final whistle wahala start. Some Kano Pillars fans vex enter pitch, attack match officials and Shooting Stars players. Di match bin start well for Pillars as Mustapha Jibrin score early for 9th minute, but Adams Mustapha […]

todayOctober 13, 2025 10

Sports

Late Joe Erico Comot Cloth, Curse Super Eagles – Oliseh Yarn

Former Super Eagles midfielder and captain, Sunday Oliseh, talk say late coach Joe Erico comot him cloth nack naked and curse Nigeria national team after e feel say dem betray am during di 2002 World Cup waka for Japan and South Korea. Oliseh yan dis one for him recent talk on Home Turf Podcast, where e also suggest say di curse fit be reason why Nigeria dey struggle for big […]

todayOctober 13, 2025 6

Sports

Mahrez Lead Di Charge As Algeria Dust Somalia 3-0

Ex-Manchester City and Leicester winger, Riyad Mahrez, show say e still dey fire as e provide cross wey Mohamed Amoura volley enter early, then bang him own rising half-volley for 19th minute. Mahrez wey captain di team play mind game with him marker before e create di third goal for Amoura 12 minutes into second half, after which dem both comot. Algeria almost add another goal from Youcef Belaili, but […]

todayOctober 10, 2025 9

Sports

Mbappé: Madrid Don Reset My Brain, Leg Don Balance

Kylian Mbappé don talk say him move go Real Madrid help am “put head and leg back for ground” and him sharp start to di season show am well. Di France striker don score 16 goals for 14 games for club and country, and e only fail to score for one match since e start him second season for Spain. Even though e take reach January to get same number […]

todayOctober 10, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app