Sports

978 Results / Page 23 of 109

Background

Sports

France Beat Morocco 2-0

By: Yusuf Abuh France don qualify for 2026 FIFA World Cup semi-final after dem beat Morocco 2-0 for quarter-final match wey happen for Foxborough, Massachusetts. Kylian Mbappé open score for 60th minute before Ousmane Dembélé add another goal six minutes later to seal di win for Les Bleus. Mbappé score di opening goal even after Morocco goalkeeper save im penalty for first half. Di result don end Morocco impressive World […]

todayJuly 10, 2026 44 7

OBODO NAIJA

France Go Face Morocco as World Cup Quarter-Final Wahala Begin

France go face Morocco on Thursday for one heavyweight World Cup quarter-final clash as di tournament don enter di business end. After one month of action wey produce 280 goals in 96 matches, only eight teams remain, all chasing di World Cup trophy wey go be decided on July 19 for East Rutherford. France, wey many people see as one of di strongest teams for di tournament, go meet Morocco […]

todayJuly 9, 2026 25 7

Sports

Manchester United to sign Chelsea Midfielder Andrey Santos 50 million

By Oluwatosin Ibrahim Manchester United and Chelsea don do two aside agree deal for brazil young midfielder Andrey Santos. Say, United go first pay £48 million, while another £2 million go come later if e meet some conditions. Chelsea also go collect 10 percent if Manchester United sell Santos in future. Santos don get permission to do his medical before the transfer complete

todayJuly 9, 2026 20

Sports

Adeyemi pick Barca, tell Dortmund say im wan comot  

By Oluwatosin Ibrahim Barcelona don submit official bid to Borussia Dortmund for winger Karim Adeyemi. According to transfer news tatafos,  Fabrizio Romano and Gerard Romero for  X (twitter) on Thursday say tuks between both clubs still dey go on but  Adeyemi don already show interest to join Barça.   According to am, Karim Adeyemi don agree personal terms with Barcelona and he don tell Dortmund say na only Barça e […]

todayJuly 9, 2026 41 6

Sports

Saudi Powerbroker Dey Push For Mid-Night Fury vs Joshua Clash For Wembley

By Oluwatosin Ibrahim Saudi boxing powerbroker Turki Alalshikh don konfam say the heavy boxing match between Tyson Fury and Anthony Joshua fit still happen for Wembley Stadium. But he check say, this one go only happen if British authorities gree make the fight start very late for night so that pipo for America and across the world fit watch am for their prime time. Because of this one, Alalshikh dey […]

todayJuly 9, 2026 19

Sports

Zeki Amdouni Fit Retire From Professional Football Dis Week

Switzerland star, Zeki Amdouni, don yarn say he fit retire from professional football once he face Lionel Messi for FIFA World Cup. He yarn dis one for him Snapchat on Tuesday after Switzerland beat Columbia. Amdouni joke say after di match, he go just end im football career. Argentina wey be defending champions go jam Switzerland for quarter-final later this week.  

todayJuly 8, 2026 39

Sports

Former Eagles captain Ekong confess say Watching World Cup for TV dey pain body

By Oluwatosin Ibrahim Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don drop bumbshell  shame wear am agbada, and caftan as super eagles nor qualify for di world cup. Im yarn dis one during one media tuk, tuk on tuesday for social media post. Ekong explain say normally, Super Eagles na di akpormiemie of any international competition and, as dem nor go dis one, say di world cup nor too sweet.  

todayJuly 8, 2026 47 11

Sports

Messi Score As Argentina Survive Egypt Scare

By: Yusuf Abuh Argentina fight back from two goals down to beat Egypt 3-2 for Atlanta and qualify for di World Cup quarter-final. Yasser Ibrahim and Mostafa Ziko bin give Egypt 2-0 lead, even as Lionel Messi miss penalty after goalkeeper save am, before Cristian Romero start di comeback with header. Messi later score di equaliser to make am nine straight games wey im don score for World Cup matches […]

todayJuly 8, 2026 22 1

Sports

Ronaldo World Cup Dream Ends

By: Yusuf Abuh Cristiano Ronaldo World Cup journey don end for heartbreak again, after Spain beat Portugal 1-0 for Dallas Stadium on Monday night, thanks to Mikel Merino late goal. Ronaldo, wey plenty people believe say na im last World Cup match be dis, try lead Portugal attack with João Félix and Bruno Fernandes but dem no fit score goal. Spain defence stand gidigba throughout di match, while goalkeeper Unai […]

todayJuly 7, 2026 26 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds