By: Esther Ayoola
Chief of Army Staff, Lt.-Gen. Waidi Shaibu, don drop update say Naija Army go do everything wey human fit do to stop di plenty terrorist attacks for Niger State and other parts of di country.
E tuk dis one dis week for Minna, Niger State, during di opening of di 2026 Doctrine and Training Conference for Army Doctrine and Training Command.
According to am, di Army dey fully ready to carry out di order wey President Bola Tinubu give dem to fight insecurity.
Shaibu say di Army no go rest until peace and safety return to all affected areas.