Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
One young woman for Iran wey dem force marry as pikin dey face execution by hanging for di murd£r of her husband unless she fit raise £80,000 to settle di man family. Di woman, Goli Koohkan, now 25, marry her cousin when she be just 12 years old, and born her first pikin at 13. By 18, she don dey for prison after court sentence her to de@th for di man k!lling. Reports say di wahala start when her husband dey beat her and dia small pikin, and she call di husband cousin make e help. Di cousin come, fight burst, and di man kpai by mistake. Goli even call ambulance and tell police wetin happen, but still dem jail her for Gorgan Central Prison for over seven years, making her di longest female inmate there.
Under Iranian law, di husband family fit pardon her if dem collect “bl00d money,” but Goli family don abandon her since di arrest. Her ex-cellmates don start campaign to raise di money before December, but dem never even gather 2% of di £80,000 wey dem ask for. Goli come from di Baluch minority wey Iran government dey always oppress, and she no even get ID papers. Human rights people talk say her story show how Iran dey treat women and minorities bad, as child marriage still legal and no real law dey against domestic vi0lence. Goli suffer plenty, her husband dey beat her, force her do heavy farm work even when she get belle, and no allow her see family or friends. She even nearly die when she born because her body small, yet di man still dey beat her for house. When she try run go her papa house, di man tell her say she go only commot from her marriage house in white shroud, meaning na death go free her.
Written by: News Editor 1
child bride execution woman forced marriage
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025