By: Esther Ayoola
Kaduna State High Court on Monday don adjourn di hearing of bail application wey former govo Nasir El-Rufai file, go April 14, 2026, as e show face for court under tight security for ICPC case.
Dem dey accuse am and im co-defendant Amadu Sule for financial misconduct and abuse of office, but court later agree to remove Amadu Sule from di arraignment.
El-Rufai plead not guilty to nine charges, while im lawyer, Ukpon Akpan, beg court make dem grant am bail, say im go obey all court conditions.