National

Cults Wey Politicians Dey Fund Na Di Biggest Security Wahala For South-East — Odinkalu

todayOctober 24, 2025 3

Background
share close

Human rights lawyer, Chidi Odinkalu don talk say di insecurity wey dey scatter South-East no be only IPOB wahala, but na cult groups wey some politicians dey fund. Odinkalu yarn dis one for Channels Television Politics Today on Thursday, as he blast people wey dey always blame IPOB for every killing and attack for di region. He talk say di biggest security problem for South-East na “cults financed by politicians,” and say people no even sabi how bad di cult matter don reach.

Odinkalu, wey don serve as National Human Rights Commission (NHRC) chairman, talk say while IPOB dey cause small trouble, di talk say na dem cause everything na lie. He yarn say some communities for South-East no even dey allow IPOB operate, so e no make sense to blame dem for all di killings and attacks. According to am, “di IPOB issue dey overblown,” and until dem face di cults wey politicians dey use for dirty work, insecurity for di region no go stop.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app