By: Alice Iduh
Delta State Police don yan say di long-time ban wey dey stop fireworks still dey gidigba as Christmas and New Year dey near, and dem no go tolerate anybody wey try break am.
CP Olufemi Abaniwonda, through PPRO SP Bright Edafe, talk say di clampdown go cover di use, sell, storage, and public show of all pyrotechnics, including knock-outs and bangers.
Di police talk say dem dey do am to stop criminals wey fit use fireworks cover dia bad moves, scare people, or escape di law.