By: Esther Ayoola
Afta all di plenty wawa online say di Department of State Services (DSS) don finally release oneĀ Pastor, Kayode Olawoye wey dem bin arrest for Ogun State since Monday.
Him family confirm say DSS don release am on Tuesday.
Say di DSS bin arrest dis Pastor, Olawoye dat im come out for internet begin complain about how some roads for Ogun State don kpafuka, dat gornment nor dey show workings.
However, onto di latest, say, di DSS don release di pastor now.