National

DSS Sack 115 Officers, Warn People Wey Dey Pose As Agents

todayNovember 5, 2025 4 5

Background
share close

DSS Sack 115 personnel, warn Nigerians against fake agents. Di Department of State Services (DSS) don sack 115 of dia personnel as part of ongoing internal reforms wey aim to strengthen professionalism and integrity inside di Service. Di secret police drop di update on Tuesday for dia official X handle, saying di dismissal happen over a period of time and e dey part of bigger effort to clean up di system. DSS also warn Nigerians make dem no deal with any person wey don chop sack but still dey pose as active operative. Di agency mention say before now, dem don already issue disclaimer on two ex-officers, Barry Donald and Victor Onyedikachi Godwin, wey dey use dia former position do fraudulent activities.

DSS come still urge di public to always confirm di identity of anybody wey claim say e be operative before dem do any official matter with am. According to dem, di full list of di dismissed personnel don dey published for dia official website for transparency and reference. “For clarity sake, di identities of di dismissed personnel don dey published on di Service website,” DSS talk. Di agency also confirm say di two former officers, Barry Donald and Victor Onyedikachi Godwin, don already dey in custody and dem go soon face prosecution as part of di Service effort to sanitize dia ranks and restore integrity.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app