National

Ecowas Declare Emergency For West Africa Sake Of Security Wahala

todayDecember 9, 2025 6

Background
share close

By: Alice Iduh

Di Economic Community of West African States, ECOWAS, Ecowas don provoke oh, declare state of emergency for all West Africa say region political and security wahala don tire dem.

Na di Commission Presido, Omar Touray, dey yan dis one  on Tuesday for Abuja during di 55th Mediation and Security Council meeting.

Touray tell im  ministers and diplomats say recent gbege show say dem need serious thinking about di future of democracy and how to secure di community.

Im release recipt of multiple attacks wey jaguda boys don do for di area and political drama  as e take  turn West Africa to danger zone, and e warn say di situation go worsen if dem no act fast.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app