National

Emefiele Naira Redesign Cause Serious Wahala For Nigerians – EFCC Witness

todayOctober 31, 2025 8 4 5

Background
share close

A Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) investigator wey dem call Chinelo Eneanya don tell one Abuja High Court say former Central Bank of Nigeria (CBN) Governor, Godwin Emefiele, na im Naira redesign policy bring serious economic wahala for Nigerians. Eneanya wey be EFCC seventh witness (PW7) talk say from di video evidence wey dem show for court, e clear say di redesign of di ₦1000, ₦500 and ₦200 notes injure di public well-well. As di prosecution counsel, Rotimi Oyedepo (SAN), dey lead am for evidence, di witness yarn say di EFCC investigation show say di policy cause heavy frustration as people and businesses dey suffer to meet dia daily needs.

Di prosecution tender plenty documents, video and audio-visual evidence, including delivery notes, notice of meeting, and bill of settlement for 2022 and 2023, as evidence. Six video clips from News Central, Channels TV, TVC News and Arise News show how people dey struggle because of di new notes. Eneanya talk say even CBN board members and governors committee only know about di president approval after e don already happen. E also confirm say EFCC interview Emefiele and e admit for im statement say di redesign no get board approval. When defence counsel Olulekun Ojo (SAN) try object, Justice Maryann Anenih overrule am and allow di witness continue. Di case don adjourn go November 26 for cross-examination of PW7.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app