Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di 16th Emir of Kano, His Royal Highness Muhammadu Sanusi II, don warn say all di bold economic reforms wey di Federal Government dey do no go bring real benefit to Nigerians if dem no seriously cut down di cost of governance. Sanusi hail President Bola Tinubu for di bold step to remove fuel subsidy, but e still show concern say di extra money wey Nigeria dey get from di subsidy removal dey mismanage. Di former Central Bank Governor talk dis one on Tuesday, October 28, for di Oxford Global Think Tank Leadership Conference for Abuja, where e analyse how Nigeria economic wahala today na result of ignoring correct advice from before.
Emir Sanusi remember 2012 when Jonathan government try remove subsidy but opposition dem protest am, only to later face di same problem. E talk say if subsidy bin go that time, di pain for Nigerians today for small wella. “I bin talk say make dem remove am that time, inflation go move from 11% to 13%, and I go bring am down within one year,” e yarn. Sanusi add say under im time for CBN, dem stop Nigeria from turning to another Zimbabwe, and even defend di current Naira rate, saying say certainty better pass confusion. “Yes, dollar dey N1,400 now, but better make we know e go remain so than make e jump tomorrow,” e talk. E end am by blasting di high spending and big government structure, ask di question wey scatter everywhere: “Why we need 48 ministers, long convoys, and endless travels?”
Written by: News Editor 1
Emir Sanusi news Sanusi Tinubu statement
todayOctober 29, 2025 72 1031
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025