Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By; Rilwan Agbomeji
Di European Union and Nigeria don agree to tighten dia security and defence relationship to tackle di security wahala for di country.
Dis one happen on Wednesday for Abuja, wen EU Ambassador to Nigeria and ECOWAS, Gautier Mignot, visit di Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, for Defence Headquarters.
Mignot congratulate Oluyede on im new appointment and talk say EU ready support Naija with stronger defence cooperation.
Di move na part of EU plan to work closely with Naija security agencies to fight insecurity and strengthen peace across di country.
Written by: News Editor 1
EU Africa security news EU Nigeria security partnership EU support Nigeria security Naija EU defence deal Naija military partnership Nigeria security cooperation
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025