National

FG Debunk El-Rufai – “We No Dey Sponsor Bandits, Na Big Lie!”

todaySeptember 1, 2025 5

Background
share close

Nasir El-Rufai wey be former governor of Kaduna State talk on Sunday say government dey empower bandits by paying dem “monthly allowance” sending food go give dem in the name of “non-kinetic,” wey e describe as “kiss-the-bandits” policy. El-Rufai talk this one for Channels Television Sunday Politics programme. E talk say, “Wetin I no go ever do na to dey pay bandits, dey give dem monthly allowance or dey send food to dem in the name of non-kinetic. Na nonsense be that. No be Kaduna State government dey do am, na national policy wey the Office of the National Security Adviser dey run, and Kaduna join body. Kiss the bandits, na the new policy be that.” E still talk say the policy dey rehabilitate bandits instead of making dem face their crimes, na wetin dey cause the insecurity wey still dey the country be this. As e put am, “My own stand be say the only repentant bandit na the one wey don die, Make we finish all of dem, Make we bomb dem until dem reduce to nothing, then the five percent wey still wan repent fit come collect rehabilitation. You no dey negotiate from position of weakness. You no go empower your enemy, you no go give am money make e go buy better weapon. Na why insecurity problem never commot and e no go commot as long as this kind policy continue.” E still talk say, “Dem fit dey deceive people, dem fit dey cover up, dem fit do propaganda, but people wey dey live for Katsina, Zamfara, Kaduna and other states sabi wetin dey really happen.”

But Federal Government don come out deny everything wey El-Rufai talk. Inside one statement wey come from Office of the National Security Adviser (ONSA) on Monday, dem talk say the allegation na lie and e no get head. Dem talk say, “For that interview, El-Rufai talk say na ONSA dey coordinate policy of payment and offer to bandits, that talk no get base. ONSA or any government arm under this administration no ever do any payment of ransom or dey give criminals any form of motivation. In fact, we don always dey warn Nigerians make dem no dey pay ransom. El-Rufai talk no just be lie, e even dey against facts wey person fit confirm for ground.” The statement wey Zakari Mijinyawa sign for ONSA explain say the government from beginning don use two methods strong military attack and community dialogue to take handle the wahala wey dey. “The result don show for places like Igabi, Birnin Gwari, Giwa and other places for Kaduna wey before suffer serious terror but now don dey enjoy small peace. Our gallant military and security people don catch or even finish some notorious bandits and media don report am. Recently, leaders of Ansaru wey set up base for Kaduna don enter our hand.” ONSA still talk say na big insult to the memory of security people wey don die make El-Rufai talk like say dem no do anything. “All these success no come easy; some of our brave officers die for this fight. For one former governor like El-Rufai to talk say all this sacrifice no mean anything na unfair and e insult the memory of those wey don die. We dey beg El-Rufai and other politicians make dem no dey use national security do politics. The fight against banditry na all of us get am, no be platform for political scoring point.”

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app